In Waec Examination, Akpors Was Ask To Complete The Following

1) He who fights and run away?
Akpors: E don surrender be dat, na fear catch am.
2) A rolling stone?
Akpors: No fit just dey roll, na person push am.
3) He who lives in a glass house?
Akpors: Na rich politician e gobe.
4) A stitch in time?
Akpors: Dey prevent futher tear tear.
5) Birds of same feather?
Akpors: Na dsame mama borndem.
6) One good turn?
Akpors: Na correct power steering fit do am.
7) A bird in hand?
Akpors: Wetin e won be again, if no be berbeque.dem plenty for chiken republic.
8] Half bread is better than?
Akpors: poff poff,buns or garriwithout sugar.
9) A journey of a thousand miles?
Akpors: Na the person wahalabe dat na..why im no enter motor or aeroplane jeje?.
10) He who laughs last?
Akpors: Get brain problem. make dem examine am because na begining of madness be dat.
11) A patient dog?
Akpors: Na hunger go kill am.
12) All work and no play?
Akpors: Na bank job be dat.
13) Once beaten?
Akpors: Na revenge go follow be dat.
14) A fool at forty?
Akpors: You never see naija own..our own dey start at 50.
15) A friend in need?
Akpors: Na parasite be dat..
HOW MANY MARKS WOULD AKPORS SCORE?

Comments